Hello naija,
Fear dey catch me for d thin wey dey go on for cambo this days. dis ground too gen for us to jolificate and make way for many things. why we no fit kool down dey follow our level tik tik as cambo talk am. why we go dey wahala our sef, why we no go fit dey united, why we no go fit live 2gada as people, as organization or even community?
Since 4 months now na gbeghe dey full ground and nobody dey send to make sure we try settle ourselves again n do things 2gada as we do am last year. Na with abeg I dey to all d people wey fit help to bring our people back n happy again. make we forgive one another and future go better for all of us.
Make I also use this opportunity to beg many of our men of God wey dey do church for phnom penh to wake up to this need. we no go fit sit don watch our past efforts just go away like dat. abeg make we try tell our people wey to go una church to show love for one another and forget many many worng thing wey dun happen for the past. we no many reach other community wey dey here like filipines, yankee and plenty others.
Many of our people dey suffer becos nobody tell dem d rite thing to do and how long we go fit allow dis kind thing to go on? our names, images, faces, companies. churches and even our country go dey spoil and we go dey carry bad bad names around. make you self check am. this kind thing no good for us. no be only people wey dey government fit help as all of us na be the government.
Guy u dun try too much as u fit make dis pidgin level n pple like us wen no go skool go fit get chance to talk d thing wen dey our mind. 1 naija
ReplyDeleteGood talk but we people suppose know say what goes round must come around. Since after election peace no dey our community again. Make we talk true, the present executive dem spoil matter well well and those wey call demself elder close eyes de look. May God helep us
ReplyDelete